hey peeps
you are welcome to my relaxation spot*wink**************
Wednesday, November 10, 2010
Waffi babe-the travails of a warri girl
My country people na how una dey?how runnings dey go.How the weather dey treat una?i hope say e dey fair to una for dia.My own be say the weather no just favour me at all at all because he don pursue customers for today,this small shed wey i get for Igbudu market ,na im i de use dey take manage myself and my family.iI hope say as i mention family you no think say i don marry?I neva marry oh,e just be carry over of my father responsibility,the guy no just gree responsible at all.U no say e get how man go dodge him responsibility sotay God go vex give am beta work wey go make am fit take care of him family and still get extra,na so my palee own be,since them born me i come get sense i no see the better work wey my palee do one day,anything we want na straight to malee because we dont't to tire hear pale complains.Na every time e go dey talk say,if God fit just bless am with one beta job enh,e go first carry us comot for that our yard for Iyara.,na so God come bless am with one kain work for nigercat.we dey d expect change but whoosai,change we no see,Iyara we no comot from,in short malee still dey suffer dey train us with the santana wey she dey sell.my palee just dey carry im money dey go carry bololo up and down ,e no still carry us comot for iyara oh,the one e go come do be say e come go marry another wife com join my mother,shuooooooo!for the one we no fit survive so?na wah oh .E pain my malee well oh,no be small cry she cry.Na im we tell our mother say make she check the situation first,nine of us wey she born palee no fit take care of,na she de take care of us, if palee contract with niger cat come finish na how e go use survive?because e clear say palee no dey save , the new shenkes ,onome na im we pity pass because she for check the situation of things before she come put head but whoosai,the normal waffi babe style na im she do ,i sure we place na excape route for her na im make am go carry belle for my palee but she for first of all reason am say iyara no be heaven at all.the way our yard be ehn,if okada drop you for the front of we house you fit use we passage burst out for two streets after.even okada dem know say if dem drop you,u tell dem to wait make you go inside go bring money na run you dey be that so as you dey climb their machine dem de collect their money fitst before movement,na dat kain place na im one young girl wan excape from her parents house go?na im be say our poverty de learn for where their own dey .Anyways na wen my palee work come finally finish na im eye come clear,onome sef come see zone reality na im she come begin dey provoke.na so she go carry de insult my mother, na im one day me and my four younger sisters gather am beat.No be small thing o,she say as e be say we wan kill her with pregnancy she no go fit stay we house again,na so she wori palee so tay ,the small bar wey dem take pay palee off for nigercat na im e carry take go rent face me i face you for onome for Emegbiren .we come get small peace for we house but we bone palee big time,e come dey expect say malee go de feed am but he no know say malee don wise.na so palee take go back to square one.na that time we come understand him life,enjoyment can never come im way.Any way sha na so onome use clear eye carry born four chilren for my palee.when she come eventually see say the suffer no be track and field she come wake up one morning,vex pack all the children come drop with my father for our small one room for Iyara,come say she no marry again.Anyways sha na so those children take become our responsibility but we still no send palee because na im carry the extra load come.So as i bin dey yarn before family problem take over.as this rain dey fall since morning so i neva fit sell anything for the akube wey i dey sell.Ehn ehn,i come dey hearsay dem don do sumtyn to we governor,wether dem comot am for seat abi dem cancel the last election.E pain some people oh.me i n o send because i no see how e take help me in the first place.i no feel the guy at all,my situation no still change so why i go wori about am?abi the iyawa for my father house no reach to keep me occupied all through im tenure?pscheeeeeeeeew,nonsense banga rice!!!!!!!!!!!!!
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment